Super Falcons victory ova Lioness mean say dem go play di host nation Morocco for Semi final. Dis quarter-final match result also mean say Nigeria don qualify for di 2023 FIFA Women's World Cup for Australia and New Zealand.

 Cameroon vs Nigeria Wafcon 2022 Quarter final match end 1 - 0 in favour of Super Falcons for Morocco.

Thursday Women African cup of Nations for Morocco game happun for Stade Mohamed V Stadium inside Casablanca.

Full Time Cameroon 0 - 1 Nigeria

Super Falcons victory ova Lioness 

2nd half match report

90' Two minutes of extra time.

89' Nigeria dey feel di pressure now late on inside di match.

88' Cameroon dey send plenty players forward and now dem get corner.

86′ Cameroon substitution Abam - comot, Kameni- enta.

85' Nigeria don switch to defence mode now wit few minutes remaining.

83' Cameroon pressure dem force Nigeria defence to make mistake.

80' Cameroon send in a dangerous ball, Nigerian goalkeeper save di ball but Cameroon player jam her as she save di ball wey make her roll for ground injured.

75′ Cameroon push to attack Nigeria but still no way for dem yet.

72' Double substitution for Nigeria Ordega comot- Kanu- enta, Okobi- comot Chikelu- enta.

68′ Cameroon substitution Fatima - enta, Mbeleck - comot.

68′ Ayinde high boot catche Abam.

62′ Third yellow for Cameroon na Onguene collect di card.

Goal' Ajibade header beat di Cameroon goalkeeper

Okobi run worry di Cameroon defense before Onumonu cross find Ajibade wey head di ball inside di net.

53' Di space between Nigeria attack and midfielder too much e

49' Nigeria get more possession for di opening minute but still lack di creativity to break di Cameroon defence.

Half Time score 0-0

1st Half match report

40' Nigeria dey pepper di Cameroon defence, wit shots from Ordega and Ucheibe.

Di winner of dis match go play di host nation Morocco.

33′ Nigeria with another corner kick but dis time no fit trouble di keeper.

28′ So far di two teams dey struggle to create clear chances.

24′ Nigeria come close!

But Mbonu wey bin dey for Cameroon goal do well to block Plumptre header.

21′ Super Falcons win another free kick

Okobi step up again to deliver but e no reach any Nigerian player.

12' Di score na 0-0 between Nigeria and Cameroon.

Some big names from di two kontries dey di stadium to watch di match.

Cameroon Legend and football president Samuel Eto and Nigeria football federation President Amaju Pinnick dey inside di stadium dey watch di match.

Dis match na repeat of di 2016 final for Yaounde, di derby dey expected to produce fireworks.

Already Zambia and Morocco don qualify for di semi-final round of di competition.

On Tuesday Zambia beat Senegal on penalties to progress while Morocco beat Botswana 2-1.

Super Falcons team line-up

16 Chiamaka Nnadozie

7 Toni Payne

5 Onome Ebi

3 Osinachi Ohale

4 Ashleigh Plumptre

18 Halimatu Ayinde

9 Ifeoma Onumonu

13 Ngozi Okobi

23 Christy Ucheibe

17 Francisca Ordega

15 Rasheedat Ajibade

Lioness team line-up

16 Ange Bawou

12 Claudine Meffometou

6 Estelle Johnson

11 Marie-Aurelle Awona

15 Colette Nzdana

18 Claudia Voulania

7 Gabrielle Onguene

17 Brigitte Omboudou

20 Genevieve Ngo Mbeleck

22 Michaela Abam

3 Ajara Nchout

Nigeria vs Cameroon match preview - Kick off time na 6pm WAT

Defending champions Nigeria play dia arch-rivals Cameroon for Stade Mohamed V Stadium for Casablanca on Thursday July 14.

Super Falcons finish second for Group C afta dia 4-0 win ova Burundi on Sunday.

Cameroon beat Tunisia 2-0 for dia final group match to finish second for Group B.

Super Falcons go dey without dia star player Asisat Oshoala wey dey out of di tournament sake of injury.

Comments

Popular posts from this blog

Gena Rowlands, Actress Brain Behind Raw Drama to Her Roles, Is no More at 94

Is Your Social Security Number at Risk? Here's What You Need to Know

"In a bid to increase awareness and resources, the WHO has declared the mpox outbreak a global health emergency